![PicsArt_11-15-05.35.29.png](https://ipfs.busy.org/ipfs/QmRpPuNmE7D2BKRLq2RdBRY111ebDn3NWMBobePjjdhmDN) One Delta girl just dey rejoice for social media o! She talk say God save her from the hands of ritualist wey won carry her do pepper soup. Make una take chair sit down make I yarn give una how the whole gbege take happen. This our black beautiful Delta girl travel from Ughelli to Otokutu town for one party like that. But as dem end the party and she dey travel come back to Ugheli, one boy come meet her, ask her say "fine girl who you dey find?" immediately she open her mouth talk say "nobody", she no kon fit remember anything again. When she get herself, she see say na only pants and bra she wear as them tie her. She kon hear the boys outside dey discuss how to sell her. One talk say make dem sell her for 900,000 naira while another one suggest another price. But after everything, God help her she come escape from dem. Na the celebration make dem pour powder for her body. Na so Delta people dey take celebrate victory. I don write finish for now. I salute una.
post_id | 66,080,466 |
---|---|
author | chimechetam |
permlink | god-save-her-from-kidnappers |
category | busy |
json_metadata | {"app":"busy\/2.5.6","links":[],"format":"markdown","tags":["busy","naijapidgin","life","true-life","story"],"users":[],"community":"busy","image":["https:\/\/ipfs.busy.org\/ipfs\/QmRpPuNmE7D2BKRLq2RdBRY111ebDn3NWMBobePjjdhmDN"]} |
created | 2018-11-15 16:38:54 |
last_update | 2018-11-15 16:38:54 |
depth | 0 |
children | 0 |
net_rshares | 3,402,201,208,899 |
last_payout | 2018-11-22 16:38:54 |
cashout_time | 1969-12-31 23:59:59 |
total_payout_value | 1.663 SBD |
curator_payout_value | 0.528 SBD |
pending_payout_value | 0.000 SBD |
promoted | 0.000 SBD |
body_length | 1,097 |
author_reputation | 1,505,836,354,279 |
root_title | "God save her from kidnappers " |
beneficiaries | [] |
max_accepted_payout | 1,000,000.000 SBD |
percent_steem_dollars | 10,000 |
author_curate_reward | "" |
voter | weight | wgt% | rshares | pct | time |
---|---|---|---|---|---|
infovore | 0 | 2,881,906,299,599 | 100% | ||
eforucom | 0 | 3,398,306,413 | 1% | ||
simonjay | 0 | 1,495,574,580 | 1% | ||
ogoowinner | 0 | 457,640,883,995 | 97% | ||
accelerator | 0 | 19,266,802,004 | 1.4% | ||
tobias-g | 0 | 7,186,004,040 | 5% | ||
effofex | 0 | 77,792,690 | 0.7% | ||
angelinafx | 0 | 5,258,157,990 | 0.25% | ||
merlin7 | 0 | 12,603,680,360 | 0.7% | ||
nfc | 0 | 12,942,567,009 | 1% | ||
hdu | 0 | 425,140,219 | 1.5% |